Flood carry four-year old pikin go for Lagos. Family dey beg make Lagosians help them find am

Share:

Papa of Azeezat four years old pikin, wey flood carri on Thursday for Agege area for Lagos talk say dem still see find d baby girl even say dem don find am enter canal for di area but dey never see am. Mr Basil Tariho talk say dem manage pick race from di flood before there pikin fall down as dem dey tear race from di house then flood come carri am.


"I carri one of di baby's and my wife carri di oda one as we dey run comot, but my senior pikin fall down and di flood carri am" na so di papa tok.Emma be barber and im wife na tailor.

Di residents say na di new road way government build for di area na in cos am bcos dem no think about houses wey dey below the gutter level. Dem also say government no build big canal wey go fit carri di amount of water wey dey come wen rain fall for di area as dey on di side way slide go down. As di rain come, e full di whole gutters, begin pack enta houses wey dey lower dan di gutter level and e also cover most of di streets wey dey for di area.

On top dis same mata Oda pipo hala say dem neva see any that kain flood like dat for dia area before.

Many pipo also dey complain say wetin cause dis wahala na new goment canal wey dem build .

E rain wella for Lagos for almost two days from Wednesday, 17 of June go reach Thursday, 18 of June, 2020. Within dat time, plenti areas including Lekki for di state complain of serious flooding.

But di lood for Lagos no be today e start, na like every year mata. For 2018 the rain tough so tay pipo run comot dia houses for Lekki area of di state bcos of how di rain mata strong.

No comments

Search This Blog