All di times way Ronaldo don lose for final for him footballing career

Share:

Napoli win there Copa Italia final take claim dia first big cup for six seasons as dem beat Juventus 4-2 for penalty.

Arkadiusz Milik na him score di winning penalty afta Paulo Dybala miss he own for Juve, before him teammate Danilo throway he own go ova di bar.

Juve wey get five Balon d'Or winner Cristiano Ronaldo wey bin miss penalty for dia Semi final match way them play against AC Milan last week.

Dis one come mean say na di second final way Ronaldo dey lose with Italian giants Juventus.

Rinaldo cry when Juve lose


Ronaldo and Juventus lose 2019 Italian Super Cup

Lazio shock Juventus that day as dem beat Juventus do Italian Champions 3-1 to win di Suppercoppa Italian.

Di five-time Ballon d'Or winner, wey commot for Real Madrid for Juventus for 2018, bin don win 14 finals dey come before now, but as Lazio beat them, that one come end dat sweet run for Ronaldo.

Ronaldo chop red for 2013 Copa del Rey final as Real lose

Cristiano Ronaldo and Jose Mourinho chop red when Real Madrid lose 2-1 against Atletico Madrid for Copa del Rey final way them play for Santiago Bernabeu.

Ronaldo score na him first score with him head from corner way Mesut Ozil play for di match before Diego Costa come cancel am with he goal to make am 1-1

Joao Miranda na him come use head score for extra-time to give Atletico Madrid dia famous victory.as

Messi vs Ronaldo Uefa Champions League 2009

Di Uefa Champions league for 2009 na big show between Messi and Ronaldo.

For di match, Barcelona waya Manchester United 2-0 to win the cup and one man grab all di hailing, the man na Messi.

Di Barca player show Manchester United players shege throughout di match wey happen for Rome Stadio Olimpico.

Portugal lose Euro 2004 final

Rinaldo cry for Portugal loss


Ronaldo cry well-well for Euro 2004, the day way Greece beat Portugal 1-0, for final to lift di cup in front of Portugal home fans for Stadium of Light.

Greece wey no too get star players beat di home nation wey get ogbonge players like Luis Figo, Maniche and young Ronaldo wey be just dey come up.

Angelos Charisteas na him score for di winner goal for Greeks' afta 57 minutes.

No comments

Search This Blog