Edo state governor Godwin Obaseki don carry kaya commot for APC go enter PDP

Share:

Governor of Edo state Godwin Obaseki don comot from All Progressive Congress way dey in power go join People's Democratic Party.
Gov. Obaseki dey campaign for PDP


Chief Press Seke Crusoe Osagie na him yan d tori yesterday.

Governor obaseki bin make him decision to commot as member of di ruling APC party on Tuesday 16th of June 2020 afta dem no gree for am to join contest for di primaries of the party governorship election.

Oga Osagie still talk say di governor "don dey ready to contest dis year gubernatorial election under PDP"

Di party for there social media account welcome di governor for inside there post afta he go pick up he membership card for di party secretariat for di state capital Benin City.

Obaseki him sef for inside tweet say he waka show say he get the ambition to seek re-election as Governor of Edo state.

Him say "He always dey committed to sustainable development and good governance of our dear state."

No comments

Search This Blog